(Watch) Sars: Falz, Runtown lead ‘EndSars’ protest for Lagos

Runtown and Falz dey lead di protest
Runtown and Falz dey lead di protest
Wetin we call dis foto, Runtown and Falz dey lead di protest

Nigerian musicians Falz and Runtown dey lead one protest for Lagos, South West Nigeria for goment to end police brutality.

Dis one dey come some days afta di Inspector General of Police give order make members of di Federal Special Anti-Robbery Squad (FSARS) and oda tactical squads no dey do stop and search or put check points for road and make dem no dey wear mufti to perform dia duties again.

Di order come in response to social media protests ontop police brutality and harassment of SARS.

Di protesters wey carry placards and banner wey dey shout “endsars” dey waka from toll gate dey go Onikan police command for Lagos to go deliver dia petition.

Di protesters say dem no want reform but for goment to end sars.

On Sunday, afta tori come out say one young man die for police hand for Ughelli, town for Delta state, (tori wey police later deny), plenti celebs bin come out to chook dia mouth inside di mata.

Naira Marley bin tok say im go lead protest on Tuesday but e later change mouth

Falz and Runtown tweet on that same Tuesday say dem go do dia own protest on Thursday.

See fotos from di protest here:

foto from di protest
Foto from di protest
foto from di protest
Foto from di protest
Foto from di protest

Watch Full Video

Similar Posts:

Author: Admin Boss

Leave a Reply

Your email address will not be published.